Walcott don sign new kontrak
Ingiland winga Theo Walcott don stop all the tok tok wey dey ground,
as on Friday, e cari hand sign new long long kontrak wit Arsenal dem
afta in don convince in manaja Arsene Wenger make e dey play am as
strika wey in like instead of wing wey dem dey cari am go.
The playa wey b 23 years kontrak for finish di seasin so and Wenger
sef wori no b small, in bin no wan make the foma Southampton playa
waka lif the klub the way wey Robin van Persie and Cesc do the Premier
Lig klub.
" I hapi no b small say i don sign new kontrak here for Arsenal, i
troway salute to everi bodi wey suppot me, especially we manaja,
everibodi for the klub and i dey para for we fans, una too much"
Walcott tell the klub website (www.arsenal.com)
" I don tok tey tey say i wan stay Arsenal, no b new mata, so i jolly
say we don chop knuckle for the mata, everi bodi dey hapi, no lele.
Wetin dey shele now b say make the team show dem swag win plenti
trophy".
Media repot tok say in sign deal for 3 and haff year wit the London
klun wey nevea win Cup since 2005,a dn in salari sef go be 100 00
pound ($159 700) everi week.
Some Arsenal fns sef go wonda weda all the kulele suppose show for in
side afta all the kain anyhow ball wey in dey tap all dis years
sef.
As e b sef the strika wey in dey shout say in wan play no too tight
like dat afta Wenger bench am wen all the kontrak wahala bin
start,
The player wey sabi run pass taxi bin score hat trick ( na three gols
b dat) for the 7-3 hamma wey dem hamma Newcastle United but e miss for
field the oda games like the 2-0 beat wey Manchesta Citi do dem lass
weekend.
Pata pata sef, still na im b Arsenal numba one gol scorer dis seasin
wit 14 gol inside all the 24 match wey in do play dis seasin
so.
" We dey jolly say Walcott don sign new kontrak wit us.. In show for
we side wen in b 16 years and since dat time in don grow, don defelop,
and in na veri veri important playa for Arsenal Football Klub and
Ingland" Wenger add.
" Theo na strong playa and na beta pesin, the way in dey tap ball plus
say in sabi run don make am ogbonge playa for we side, weda na from
wing or for inside middle
" E good for us say in don sign, in don gif us korrect stand now becos
we get young young players wey don cari seat siddon wit us and we go
wan dey succesful wit dem as a group sef.
Walcott wey go follow Arsenal go play Chelsea for Sunday, don score
four gol for Ingland inside the 30 match wey in don play for dem