Bayern appoint Guardiola as coach
Bayern Munich don show say dem mean serious business ,afta dem announce say the ogbonge coachi Pep Guardiola wey be Barcelona foma coachi and wey lid dem win plenti plenti cup with the correct tapping
wen dem det tap don gree make become dier coach, come replace Jupp Heynckes wey dey waka wen seasin finish
Guardiola wey b 41, go enta the coachi chair afta Heynckes sef decide say in no go extend in kontrak and the Spain Coachi don gree for the deal wey go sign am stay for Bayern Munich reach June end for 2016, Bayern bin tok for statement for dier website (www.fcbayern.telekom.de) for Wednesday.
" We dey hapi say we manage convince the ogbonge football winch Pep Guardiola, wey everi klub dey find, many many klubs bin dey tok to am, but we jolly say na Bayern Munich in come" Bayern oga pata pata
Karl-Heinz Rummenigge tok.
" Pep Guardiola dey among world best for coaching and we sure say in come bring korrect swag, with korrect system come Bayern Munich and Germany football sef," in add.
Bayern announcement don end all the amebo gist and rofo rofo gist wey bin dey circulate as per na which klub in go land, Guardiola sef bin announce dis month say in go come bak next seasin afta e cari one year
say make in rest
In bin resign as Barca coachi wen lass seasin finish, afta in don lead the La Liga klub wey in start in career as player, win 14 trophy inside four years, wey include two Champion Lig cup plus 3 Spain La
Liga title wey in win for three straight years.
Na korrect waka for the Germany klub wey come secon for Champion Lig
lass seasin, as per all the big big klubs wey get kulele scatta pass
sef, Chelsea, Manchesta City and Paris St Germain all bin dey line dey
pray say dem go fit hire Guardiola
Guardiola bin yarn dis week for Ingiland FA 150 anniversay wey den
organise say na in ambishun tomanage team for Ingiland Premier Lig one
day
Guardiola time for Barca ( na in fess coachig waka b dat) na gbam,
Barca kollect beta fans with the korrect tapping wey dem dey tap, the
swag too much sef, possesiion footbal of the highest order show, come
see passsing, shangaloo join sef, na one touch waka, ogbonge
possession football wey scatter Spain and Europe.
PLenti pipu dey tok say na dier foma coachi/playa Johan Cruyff create
Barca style, Guardiola sef play
for the Coachi wey come from Holland dat time during the 1990 time wen
the klub bin win deir fess Europe Cup.
The foma Spain Intanashunal kollect plenti praise as per na im allow
Messi make e find space for firld dey deal with pipu more than the
foma coach Frank Rijkaard do.
BEFO BEFO THINGS
E remain to c weda Guardiola parole go fit Bayern and Bundesliga sef.
Anoda gbege be say, e fit hard am small becos e no go be like Barca
wey b say almost all the playas comot from dier academy reach fess
team.
But wen in reach dere, in go meet in broda from Spain Javi Martinez
wey join Bayern dis seasin.
Guardiola sef go wan cari some of in foma paddy enat Germany, make dem
join hand with Martinez, the mata get as e be becos Barca presido
Sandro Rosell don warn am say make in no cari eye look in
playas
Bayern dey numba one for Bundesliga, take cari nine point everibodi
afta the 17 match wey dem don play. The Lig go resume dis week afta
dem cari one month rest becos say na snow yime for Europe, and dem go
knack head wit Arsenal for the quata-final for Champion Lig wen the
kompitishun resume next month