Reason why I call Dike, Ameobi - Keshi
by Temisan Okomi 26 December 2012, 11:18
Naija Supa Eagus coachi, Stephen Keshi, don tok why he put Shola Ameobi and Bright Dike name for hin Nations Cup ‘play-play’ list.
De two of dem dey among 32 playa wey Keshi don hail to follow show talent, bifor he go choose de main de main team wey hin wan carri go play Nations Cup for South Africa.
Keshi tok say de two guymen bin work like jackie, sabi hia word and sabi gree-die wen dem tap ball for Naija, dat time wey Eagus play Venezuela for U.S (Yankee) las mont.
“Shola don tay for inside ball. Wen he enta de match, all of us take eye see wetin he sabi do, weda he hol ball or he no hol ball. Even sef, de tin wey he know for ball plenty and he fit de tell oda playa dem to behave well for field. Na wetin go helep de team for match.”
“Bright (Dike) show wen time don almos reach to play Venezuela. Hin gree-die no be beans. He get power well well, he sabi run and dey work like jackie. De main tin be say; de guyman dey hia word and na dose kin men I dey like follow waka”, na im Keshi tok.
Ameobi and Dike follow dey among 18 playa wey dey tap dia ball for obodo oyibo, wey Keshi hail for de ‘play-play’ (na pencil dem use rite am. De main de main list neva comot) team wey fit go Nations Cup.
De playa dem go enta camp for Faro, inside Portugal, for January 5.