*All times CAT (GMT+2)

Football | Naija Tori

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience

Inury wahala for City



Wahala dey for Manchesta City dem as dem plan to catch Manchesta United on to d Lig table don jam wall, as dem ogbonge players don dey fall yakata wit wound up and down efen as dem dey start d krismas jollificate wit match wey dem go play Reading for Saturday. Na 6 point Manchesta gap dem and d wahala be say dem kaptain Vincent Konpann and Samir Nari fit miss d match wen Reading go show for Etihad Stadium. Kompany bin comot for d match wey dem play United with injuri, and efen make am miss dier 3-1 win wey dem win Newcastle. Nasri sef bin get d same kain injuri for d Newcastle match. Like say e neva do for Mancini, midufilda Jack Rodwell don talk say e be like na till year start befor im go fit tap ball again, for d wound wey im wound since Octoba time. " Na small wahala wey show again, i bin tink say d wound don heal sef" Rodwell tel City webusite. " E be like na to add small week on top, so na to look next year b dat" Mancini dey expect say dem go win Reading kollect 3 point as per say na d same Reading wey Arsenal hamma 5-2 . City fit gif Manchesta Uinted bumpa to bumpa with 3 point if dem beat Reading snce United sef no go play till aftanoon time for Sunday. Krismas go get as e be finside Premier Lig becos na four time dem go play for d period inside 12 days so. Na Arsenal go open d wikend gbedu for house as dem go play Wigan wey b numba 3 from d back, and if dem fit manage win, dem go go numba 3 for table be dat. Arsene Wenger dey hapi say 5 of im young players dem, don add join for dem kontrak and e go gif dem confido. Tottenham wey dey numba 4 go play Stoke City and Chelsea sef wey dey numba 3 go play Aston Villa wey scatta Liverpool 3-1 for Anfield lass wik. Everton wey drop enta numba 6 for table go jam West Ham and West Bromwich Albion dey house dey wait for Norwich. Afta dem don win deir fess game dis season so, Queens Park Rangers go carry confido enta dem match for house wit Fulham dem Na d full match be dis for Saturday (all d time na 4 for evening for naija, except where dem no talk so) Wigan Athletic v Arsenal (1245GMT), Newcastle United v Queens Park Rangers, Tottenham Hotspur v Stoke City, Manchester City v Reading, West Bromwich Albion v Norwich City, West Ham United v Everton, Southampton v Sunderland, Liverpool v Fulham (1730GMT)

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Sports Talk



John Dykes
A day for sentiment, stats and hard cash
The title may have been won weeks ago and the relegation issues settled seven days back but there...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...

Neil Tovey
Khune top of the class
Kaizer Chiefs are on the verge of clinching their first league title since 2005. One man’s name is...

Clyde Tlou
Enough is enough with racists
We love it so much and even call it the beautiful game but the beauty of this game we love so much...