*All times CAT (GMT+2)

Football | Naija Tori

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience

Naija no get problem for goal



Ike Shorunmu wey b d Oga Kochi for d goalkipas for d supa eagus of Naija say wahala no dey atol for him department.

Na 3 goalkipas wey dey play dem futbal for Naija ligue na dem dey camp now for Abuja and dem b Chigozie Agbim, Daniel Akpeyi and Femi Thomas for wich all of dem go fight make Oga Keshi take dem go South Afrika for d AFcon.

E b like say na Vincent Enyeama and Austin Ejide wey b goalkipas for obodo oyinbo na dem go join d 17 playas wey dey play dem futbal for yurope, but Oga Keshi neva call d name.

Oga Shorunmu tok say make Naija no worri jaree as him promise say na by fom na hin dem go take select all d 3 goalkipas wey go travel go AFcon.

“Three of dem wey dey here dey try since we don open camp on Monday and I want make dem cari on as we no get any wahala for our goalkipas.

“D only wori wey dey ground na who to pick go AFcon but na all of dem dey fit to chalenge dem mates wey dey come from obodo oyinbo,” Shorunmu tok.

Shorunmu aded say na by merit na hin dem go take select playas wey go folow dem go d ogbonge AFcon kompetison for South Afrika.

“No bodi dey sure of shirt among all of dem weda u dey play for obodo oyinbo or Naija, na wetin dem sabi for camp na hin go tok for dem,”

Keshi and him koches go name d 17 playas wey dey play for obodo oyinbo bfor xmas as dos wey dey play for Naija go travel go Portugal for dem fina preps.

D supa eagus of Naija dey group C and dem go play Burkina faso, Zambia and Ethiopia.

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Sports Talk



Dr Errol Sweeney
Why are referees explaining their decisions?
Match officials make mistakes because they are like you and me - human. However, in modern...

John Dykes
A day for sentiment, stats and hard cash
The title may have been won weeks ago and the relegation issues settled seven days back but there...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...

Neil Tovey
Khune top of the class
Kaizer Chiefs are on the verge of clinching their first league title since 2005. One man’s name is...