Osun get hope for futbalu
by Own Correspondent 04 December 2012, 19:32
Osun Women's futbalu team go play dem fina game today and dem must beat team Enugu if dem won go for d next stage.
D Osun Women don win two of dem game and dem lose one for d group stage Y Enugu too don win dem two games wey dem don play sofa for dis ogbonge Naija festiva.
D match betwin two of dem today go toffu bcos two of dem won enta d next round of d tonament.
Oga koch of team Osun, Liadi Bashiru tell supersport.com say him blieve him women go fire Enugu today.
“Our plan na to go d next round and Enugu no go fit bloc us for road, walahi anyhow d thin go b, today na today my women go beat dem,” Bashir talk.