Coaching no dey my mind-Kanu
Nigeria Skippo before before, Nwamwko Kanu alias Pappilo don talk say lai lai im no fit become coachee at all all.
Tori wey bin comot for some media bin talk say Kanu dey try be among the people dem wey they coach the national team, but Kanu talk say to become coach na d last tin wey dey im mind.
" i no wan become coach. I no wan be member for the coaching crew sef" Kanu talk But, the striker wey play for AFC Ajax before, talk yarn say im no go mind " ogbonge arrangee" for Super Eagle waka.
" i go like position (for super eagles) wey be say anytin we wey talk, anytin wey we arrange, dem go use. No be juss to arrange sometin wey dem go jes throway like dat". Him talk.
Kanu, wey play profeshunal ball for obodo oyibo for Internazionale, Arsenal, West Brom Albion and Portsmouth talk say him dey expect Nigeria Football Federation NFF) arrange that kain parol for the team gon gon if d team level go improve at all at all.
" If dem manage arrange that parade, den i dey sure say our ball go begin dey show levels again. Him talk.
Kanu bin first play for naija for 1994 and im don score 13 gol for Super Eagles inside the 86 match wey im don play.