*All times CAT (GMT+2)

Football | Naija

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience
Atletico Madrid © Action Images

Atletico, Real jamm for final



Atletico Madrid go follow Real Madrid play final for King Cup afta dem play 2-2 draw wit Sevilla on Wednesday.

E mean say Atletico win de two leg 4-3, bicos dem bin waya Sevilla 2-1 for fes leg.

Na Diego Costa bin score Atleti two goal for fes leg, and na im start de gbege again, wen hin faya beta shot as match jus dey reach six minit.

Costa don score seven goal for dis King Cup now, meaning say hin dey gap all man. Real Madrid playa, Cristiano Ronaldo don score six, de same wey Sevilla strika, Alvaro Negredo, don score.

Diego Costa (na Brazil hin come from) come tear race for left wing, send nasa wey Falcao faya enta net as match reach 29 minit.

Na Sevilla bin dey house, and na so dia supporta jus dey hail dem. De tin ginja Jesus Navas and he jus bend one kin ball wey enta bet as fes haf wan finish. 2-1.

Sevilla bin waya Atletico 2-kondo for final for 2010, and na so dem press Atleti die, for second haf.

Atleti defend faya, and na wen match don enta mortuary time na im Ivan Rakitic come score Sevilla ekwaliser.

By dat time sha, Sevilla don vex like deaf and dumb. Refree bin don give Gary Medel red card wen match remain 14 minit. Geoffrey Kondogbia come colet hin own as match finish. De two of dem bin foul Costa.

Atletico don win King Cup nine tines and na Real Madrid dem go follow play final on de 18 of March, afta Real bulala Barcelona 4-2 for dia own two leg.

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Sports Talk



Dr Errol Sweeney
Why are referees explaining their decisions?
Match officials make mistakes because they are like you and me - human. However, in modern...

John Dykes
A day for sentiment, stats and hard cash
The title may have been won weeks ago and the relegation issues settled seven days back but there...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...

Neil Tovey
Khune top of the class
Kaizer Chiefs are on the verge of clinching their first league title since 2005. One man’s name is...