Madrid wire Barca
by Andrew Randa 27 February 2013, 07:05
No b small tin wey hapin for Camp Nou for the secon leg of Kings Cup
wey Barcelona play wit Real Madrid. Cristiano Ronaldo scatta Barca
defence come score two gols for the 3-1 wey dem waya Barca, come cari
Madrid enta final wey dem go play Atletico Madrid abi Sevilla.
The tin b like magic no b small, The Portugal strika become the fes
playa to score for six strait 'Clasico' away from in house. Gerard
Pique bin foul the guyman inside eitin, and in sef gada bodi, stand
up, hama korrect penarity pass Jose Manuel Pinto wey dey Barca post
for the 13 minut.
As per normal normal, na Barca dominate ball, but dem no too wori
Madrid defence sef, and Ronaldo sef come show insef, as in run hama Di
Maria rebounce wey fall for in road, pass Pinto for the 57
minut.
Na the numba 12 gol wey in don score for the 18 times wey in don play
Barca since in enta Madrid for 2009, and also, na the secon time in
dey score two gol for the lass teo match wey in don play for Nou Camp
b dis.
Real come do Barca strong tin, add salt on top injuri as dia defenda
Raphael Varane, wey bin equalise for the fes leg wey dem play for
Bernabeau, nod beta nodding for the 68 minut enta Barca net from kona
kik wey Madrid take.
Barcelona kontinu to dey press, but dem bin no fit Madrid defense as
Jose Mourinho, siddon for bench dey jolly as in boys dey cari Barca do
oyoyo for am.
Barca manaj comot small shame for face as Jordi Alba score for dem for
the 89 minut, but upon all the gre gra time bin don pass and notin wey
Barca fit do, and na the fes time Barca chop gols for house agains
Real since the 3-3 draw wey dem play for March 2007