Gunners still dey make gain
by Andrew Randa 27 February 2013, 07:08
England Premier Lig klub Arsenal don hama no b small, dia six mont
proft wey dem bin anounse on Monday don dey reach dat kain £17.8
million ($27 million), but e no kuku reach d one wey dem been get for
lass year wey b £49.5 million.
Statement wey the north London rilis tok say dem spend £40.9 million
take sign Lukas Podolski, Santi Carzola and Olivier Giroud plus take
am extend the kontraks for dia England playas Theo Walcott and Jack
Wilshere.
Playa wey dem sell gif dem 42.5 million, as the kulele wey dem raise
bin drop to 106 million from the 113.5 million wey enta lass year
becos dem no play plenti match for house reach las year.
The profit wey dem make for the six monts reach Novemba 2011 inklu the
moni wey dem get wen dem sell Cesc Fabregas, Samir Nasri and Gael
Clichy.
Stan Kroenke, wey get shapre pass for Arsenal tok say debt no too dey,
plus moni wey dey ground now reach 123.4 million pass last year own
wey b 115.2 million.
"We dey kampe for dis side and Europe sef becos of how we dey do
bisness wey dey gif us korrect stand " chairmo Peter Hill-Wood
tok.
Arsenal fans don dey vex no b small, dem dey provoke say dia klub neva
win cup since 2005 wen dem win the FA Cup and dem dey push manaja
Arsene Wenger make in comot ogbonge moni buy beta playas take replace
Fabregas and van Persie dem, wey dem sell gif Manchester United dis
year.
The klub bin waka comot for Lig and FA Cup dis seasin as as e b, Na
onli miracle go make dem escape from Bayern Munich hand afta the
Germany klub hama dem 3-1 for house for the fes leg for the Champion
Lig round of 16 wey dem play.
Wenger, wey in kontrak go kpai for the end of nes seasin, don relax
small afta Arsenal manage beat Aston Villa 2-1 for Premier Lig afta
Bayern beat dem and Blackburn Rovers do dem strong tin for FA
Cup
Arsenal dey numba five for table for Premier Lig for dia nebo
Tottenham bak, cari one leg comot for space for Champion Lig. Dem go
kuku play Tottenham for White Hart Lane dis Sunday wey dey come.