Uche na baba for Turkey
by Andrew Randa 25 February 2013, 08:41
Naija midfilda Kalu Uche dob become the numba on gol scorer for Turkey
Supa Lig after in score for Kasimpasa wen in klub bin lose 1-3 to
Fenerbahce for match wey dem play on Sunday.
Uche bin score the gol from penarity kik wey in take for the 2nd minut
for the match.
The korrect playa now don arrange beta 13 gol be dat, pass all the
strikers dem wey dey Turkey Supa Lig.
Fenerbahce Cameroun striker Pierre Webo behind Uche back with 12 gols,
and Umut Bulut and Burak Yilmaz wey dey play for Galatasaray don also
hama 12 gols dis seasin.
The 30 years playa wey Keshi no cari go the Africa Cup of Nations wey
Naija win don play 30 times for the Supa Eagus. In fes match for Naija
na for 2003 for the match wey Supa Eagus play Angola for Benin
Him don also score 5 gol for the Supa Eagus.