Reuben wan flog Kenya
by Ibitoye Shittu 25 February 2013, 08:32
Naija Super Eagles midfuda, Gabriel Reuben don yarn us for supersport.com dat him don dey readi bambam to tap beta ball ness month wen de Naija team wey be de new chairmen for African futball go face Kenya.
Na for de road wey dem wan take waka go de 2014 world cup for Brazil na him two of dem go jam and na de stadium wey dey for Calabar na him pipu go watch who sabi fite pass bitwin de two of dem.
Reuben also yarn say him wan make him oda timates for de Super Eagles to foget about dia swagga for de 2013 Nations cup wey dem win for South Africa, as de guyman wan make dem prepia well well on how dem go take bulala Kenya on March 23.
“Senior man, I tank God ooo as my name don enta Naija history book of de playas wey win de 2013 Nations cup becos na de fess time be dat for my life wey I go show for de Afcon.
“Wetin dey hawa head now na to flog Kenya as you know say na all de teams wey go play us now go wan beat us for dem to get mouth, but I bilif say we go qualify for de world cup in Brazil,” Naso de Kano Pillars midfuda take yarn us for supersport.com.
Gabriel Reuben dey among de six Naija Lig playas wey de Super Eagles coachi, Stephen Keshi carri go de 2013 Nations cup for South Africa.
Na de Super Eagles of Naija dey top Group F for de road to Brazil 2014 world cup with 4points as dem bulala Namibia 1-0 for dia house and dem also draw 1-1 with Malawi for Blantyre las year June.