*All times CAT (GMT+2)

Football | Naija

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience
City © Action Images

City kolobi Chelsea, Newcastle win



Manchester City use two hand hold second afta dem waya Chelsea 2-kondo on Sunday, for Premier lig.

Man City goalie, Joe Hart, bin catch penarity wey Frank Lampard faya, den Yaya Toure and Carlos Tevez come score dia goal for second haf.

E go hard City win lig again, but dem don dey use seven point gap Chelsea and na 12 point Man United dey carri gap dem now. Tottenham Hotspur sef fit gap Chelsea, if dem waya West Ham on Monday.

City manaja, Roberto Mancini bin pack midfilda full hin team, de same tin wey Chelsea manaja, Rafael Benitez bin do. Onli say Benitez keep John Terry and Fernando Torres ontop bench.

City bin start match wit onli Sergio Aguero for front, but na dem show Chelsea pepper for fes haf.

Chelsea goalie, Petr Cech work like jackie for fes haf, as he carri hand push one ogbonge header wey Matja Nastasic nod, over de bar, bifor Gary Cahill block Zabaleta shot wey wan enta net.

Jack Rodwell neva tap ball for City since, and Mancini put am for team. Na hin come wan wound Cech for fes haf, as he faya one ball from far place wey Cech push comot, bifor he come nod de corner wey Cech catch again.

Na Chelsea come get beta chance to fes score wen second haf start, becos refree tok say Hart bin foul Demba Ba for inside 18, come blow pena. Hart show hin skill sha, as he save beta shot wey Lampard faya.

De tin come faya City, and Aguero lob one kin ball wey jus be ova de bar. All na tori, becos City come score wen match reach 63 minit.

Yaya Toure colet pass for David Silva hand, dribbu four defenda bifor he bend ball pass Cech, enta net.

Carlos Tevez come put full stop wen match reach 85 minit. He colet ball for outside 18 come waya beta bullet wey Cech for no catch lailai.

Na so match come finish 2-kondo.

Na two match bin dey on Sunday sha; Newcasu bin follow Southampton play.

Newcasu waya dem 4-2 for match wey be like koso.

Sake of say Newcasu don gada many French playa, dem kuku do naming ceremony for de match. Dem bin name am 'French Day' and dem give dia supporta cap make dem wear, come even play French national antem bifor match start.

All dat one be like tori becos na French man wey dey tap for Southampton fes score. Midfilda Morgan Schneiderlin faya shot enta net afta Rickie Lambert nod header give am as match jus reach three minit.

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Sports Talk



John Dykes
A day for sentiment, stats and hard cash
The title may have been won weeks ago and the relegation issues settled seven days back but there...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...

Neil Tovey
Khune top of the class
Kaizer Chiefs are on the verge of clinching their first league title since 2005. One man’s name is...

Clyde Tlou
Enough is enough with racists
We love it so much and even call it the beautiful game but the beauty of this game we love so much...