Ghana connection help Milan skata Barca
by Andrew Randa 21 February 2013, 15:22
Wahala dey for Barcelona as dia parade to try win dia numba four
Champion Lig cup don get k-leg afta dem lose 2-0 to AC Milan for
Wednesday, minwhile Galatasaray and Schalke draw dia match 1-1 for
Istanbul.
The Catalan boys wey b oga for La Liga bin no fit brek Milan for the
fess leg for dia last 16 match wey dem play for SanSiro, na the same
place wey Inter Milan beat dem for 2010 semifinal.
As usual na, Barca control tins, cari possession, but dem no fit find
beta space, and na dat one come be the wahala as Milan sef come dey
play konta atak.
Milan, wey neva lose for the lass seven Seria A match wey dem don play
for 2013, but dem frustrate Barca die and dem come score for secon
haff, na dem Ghana boys Kevin-Prince Boateng and Sulley Muntari score
the two gols.
Boateng score from near the eiteen before 60 minut afta Riccardo
Montolivio free kik bin luk like say e touch Cristian Zapata hand come
fall for Boateng.
Barca sef come protes say the ball touch Zapata hand but Scotland
referee Craig Thomson no send dem, and the gbege come inkris for Barca
as Milan come cari the game reach dia area. Stephan El Shaarawy
arrange korrect pass gif Sulley Muntari, and the Ghana midfilda no
waste time scatta ball enta net pass Victor Valdes.
" Milan organise demself well well, we kontrol tins for fess haff, but
we no too create chances the way wey we for like" Barcelona assitan
coachi Jordi Roura tok.
" The result no too gud, but yawa neva gas"
Milan coachi Massimiliano Allegri tok say the reslut na ogbonge one
for in team " na beta win for us" kom add say " i neva bilif say we go
enta secon leg wit 2-0 advantage"
For the oda game wey dem play for Instanbul wey pipu no too send, the
game still dey as per Galatasaray bin stat dia two playas wey dem sign
for transfa windo, Wesley Sneijder and Didier Drogba wen de welkom
Germany team Schalke enta Turkey.
But na anoda Galatasaray player shine tochlite, as Galatasaray score
for the 12 minut
Burak Yilmaz score in numba seven gol inside seven matches for
Champion Lig dis seasin, foma Schalke playa Hamit Altintop bin also
hit bar.
Schalke sef bin create beta chance come equalise befor haff time as
Jefferson Farfan lay beta pass reach Jermain Jones to take
score.
" We dey hapi wit the result" Jones tok, as in team Schalke dey cari
the away gol go wait make Galatasaray show for Germany.
" Small small mistak bin dey, dem come score us, but at all at all ,
we play well"
" The gol wey we score gud well well, we go take see wetin we go do
afta, we don get respeck"
Galatasaray midfilda Nordin Amrabat gree say " No be long tori, the
koko be say we gast to score, win the secon leg, but e no go
easy"
Dem go pla the two secon leg for March 12.