Manchester United fit jam Chelsea
by Andrew Randa 18 February 2013, 18:59
FA Cup champion Chelsea go fit face Premier Lig lidas Manchester United for Old Trafford for the quatafinal if the two, win dia fifth round match wey dem go play.
United must beat Reading for dia lass 16 match for Monday and Chelsea
sef, wey hamma Brentford 4-0 for dia fourth round replay for Sunday,
suppose beat championship klub ( na secon difishun b dat )
Middlesborough wey dem go meet for February 27.
United bin lass reach the FA Cup final for 2007, and dat time Chelsea
beat dem 1-0 for Wembley, Didier Drogba score the winnin gol for
inside extra time.
Manchester City, wey win the cup for 2011, go dey house dey wait for
Barnsley.
Na on Sunday dem do the draws for the quatafinal, korrect matches dey
ground boku, Everton go nack head wit dia Premier Lig mates Wigan
Atletic if David Moyes and in boys go fit do Oldham Atletic strong tin
for the replay wey dem get for Goodison Park. Oldham bin score late
late take equalise 2-2 for the draw wey dem play Everton on Saturday
cari the match enta replay.
Blackburn, wey embaras Arsenal 1-0 for dia bakyad go play Millwall wey
play the final for 2004.
Na the komplit draw b dis:
Oldham Athletic (III)/Everton v Wigan Athletic
Manchester City v Barnsley (II)
Manchester United/Reading v Middlesbrough (II)/Chelsea
Millwall (II) v Blackburn Rovers (II)
* Dem go play the matches for d wikend of March 9/10