Surgery for David Villa
by Andrew Randa 12 February 2013, 06:52
Barcelona strika David Villa don enta hospital becos of appendix wey
dey wori am, and e fit be say in no go fit play Saturday lig match wey
Barcelona get with Granada, the La Liga champion dem tok for
Monday.
The 31 years Spain intanashunal go do operashun take trit the wahala,
Barca tok for statement wey comot for dia website
(www.fcbarcelona.es)
Villa sef bin dey try shake bodi dey kampe from the leg wey in break
before befor for the Club World Cup wey dem play for 2011.
The ogbonge strika don score five gol for inside the 15 match wey in
don play dis seasin so, come add anoda five join for King's Cup wey
dem dey play but neva score for dis seasin Champion Lig.