Santos back to Brazil
by Andrew Randa 12 February 2013, 06:32
Arsenal Brazil defenda, Andre Santos don go back house konnect wit
Gremio for loan afta shirt hard am for Arsenal fess team, the Premier
Lig klub bin announse for Monday.
The 29 years playa, wey waka enta Arsenal for 2011, don play onli 36
times for the Gunnas even as e hard am make in take ajus to how
futobal dey for England.
Manaja Arsene Wenger bin sign Spain defenda Nacho Monreal for the lass
day for dis Januari transfa windo wey juss close, as in dey nack head
weda make e cari shirt gif Andre Santos make e start match as the
numba one playa for the left area for defence Kieran Gibbs don
injur.
The Brazil playa bin join Arsenal wen i lif Fenerbache wey dey Turkey,
and the guyman sef don play for Brazil for Corinthians, Atletico
Miniero, Flamengo and Figuerense.