*All times CAT (GMT+2)

Football | Naija

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience
Juergen Klopp © Action Images

Klopp tells Blues 'tufiakwa'



Borussia Dortmund coachi Juergen Klopp don tell Chelsea say make no even wori demsef say dem dey find am make in come coach dem, say in no want at all at all, as per the onli tin wey dey in mind na to finish in kontrak wit the Germany team wey go cari am reach 2016.

The 45 years coachi bin dey high high for Roman Abramovich list wey go take replace dia careteka manaja Rafael Benitez wen seasin finish.

But for intaview wey comot for London Evening Standard for Monday, Klopp tok say make Chelsea no waste dia time ask am sef.

" I get kontrak wey go kpai for 2016" Klopp tok, " I don yarn reach 20 time say i go dey here kamoe till 2016 time" Everibodi dey tink say na mouth i dey make becos team like Chelsea abi Real Madrid fit come den me go waka. Na sometin wey i no fit change, but make dem wait see na.

" I bin coach Mainz reach seven years before Dortmund show, evri year sed i for waka enta any Bundesliga klub, but i say 'no, i get kontrak, i go stay'. I like wetin i dey do for here for Dortmund, na korrect klub, the Citi sef tight, everytin dey kampe..

" Na big tin for my side say pesin like me wey come from one kain small village wey dem dey cal Bretten for inside the Black Forest where na onli 1 500 pipu dey lif, say somebodi fit luk me say i go fit coach Chelsea, dat one na korrect tori, but i no dey tink am."

Klopp kuku say even if Chelsea drop korrect kishi, e no fit make am waka lif Dortmund.

' I bin get the same parole dat time wey i dey Mainz" in tok." No b moni mata for my side, i get moni to chop three times a day. Na big honor, but as we dey now, i no dey market, abeg make dem no vex."

Dortmund sporting direkto Michael Zorc tok say make Chelsea no kuku waste dia time

" Make dem no ty phone us sef, e no go hapin, a liss till 2016" in tok

" Even if dem wan pay us kompensashum, da ansa no go change, na no. I know say we no too get moni, but we no nid am. Na our parade b dat. We dey togeda for the mata"

Klopp bin coach Dortmund win the lig for 2011 come win both the lig and the Cup for 2012.

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Sports Talk



John Dykes
Wunderbar Wembley date
I’m honoured to be part of SuperSport’s presentation team for this weekend’s Uefa Champions League...

Neil Tovey
Why Baxter’s way has worked
When Kaizer Chiefs first announced the appointment of Stuart Baxter, the decision was met with a...

Dr Errol Sweeney
Why are referees explaining their decisions?
Match officials make mistakes because they are like you and me - human. However, in modern...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...