African Champion go play Iron Warriors
by Temisan Okomi 11 February 2013, 10:43
Numba one team for Africa, Naija Supa Eagus , go start dia 2013 Fifa Confed Cup waka wen dem go follow Tahiti play for Brazil for June.
Naija dey inside Group B wit Spain, and Uruguay, for competition wey champion of all futbal federation dey play.
Naija bin waya Burkina Faso on Sunday to carri Nations Cup for inside South Africa, afta Sunday Mba score de onli goal for de match.
Naija coachi, Stephen Keshi tok, afta de match, say e humble as na im and Naija go carri Africa flag for Confed Cup.
”To win for here no be small tin and to come carri Africa flag for Brazil for Confed Cup na heavy matta. Our belle sweet well, well. We go wait till we reach Brazil sha,” na im Keshi tok on Sunday.
Contri wey dey Group A for Cconfed Cup na Brazil, Japan, Mexico and Italo.
Naija match for Brazil 2013:
June 17: v Tahiti (inside Belo Horizonte)
June 20: v Uruguay (inside Salvador, Bahia)
June 23: v Spain (inside Fortaleza)