*All times CAT (GMT+2)

Football | Tori for Pidgin

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience
Mali © Backpagepics

Double wahala for Mali



Na beta wailing bin full Bamako (Mali capital) on Wednesday, afta Naija bulala dem 4-1, as de whole contri bin dey pray say make dia team enta final.

"Eyah!" na im dia supportas dey halla, as dem dey look de match for television for inside one market for Bamako.

Mali dey fite one kin gbege for dia contri and "if to say we reach semifinal, e for comot our mind for de gbege wey dey house," na im Diakari Dia dey halla, as he dey voke for "playas wey no sabi, dey fall anyhow and French coachi wey no sabi anytin."

Many pipu for de market change de channel for haftime, wen Naija bin dey lead 3-kondo.

For one waterside area, de owner of one small beer parlor tok say many guymen stand up waka wen e be like say Mali no go fit ekwalise.

"Afta de fess goal, all man quiet. Afta de second one, pipu dey feel say Mali fit still do sontin. As third goal enta, na so haf of my customa waka comot. Wen Naija score four, na onli gree-die men remain," na im Ibrahim Tounkara yarn.

One sine dey de front of the beer parlor. E tok say "One Mali join titi lailai."

Tounkara tok say na around las year dem put am dia, afta serious gbege bin hapin for Mali, as some pipu dey fite.

E no too tay bifor France come helep Mali and na dem dey front as dem dey fite gbege wey don reach 27 days now. Dem dey fite pipu wey wan divide de contri.

"War and futbal no be de same sha," na im Tounkara tok, even tho he tok say de tin pain all man for dia contri wey "ball don be like religion."

For inside de market, law student Mohamed Diarra jus dey hail Mali skippo, Seydou Keita, even tho he no score any goal.

"We send Keita well, well! He sabi fite and he dey always fite for Mali."

Boubacar Guitteye dey draw and he tok he no dey like join ball wit politics onli say "pipu for happi well, well if to say we win, espeshally for de part wey serious gbege dey hapin."

"To dey lose match no be new tin for us sha. E dey pain but we go forget am."

For one small part of North wey dem dey call Douentza, gbege bin serious for dia and de pipu wey bin dey cause war bin dey dia reach 10 month, till France soja come free dem. Wen de match bin dey hapin, evritin stop.

Nepa no dey dia, but all man use 'I beta pass my neighbour' as match wan start and na so men gada round television.

"We bin wan make dem win. Na two win we dey bin dey fin; one for Nations Cup and one for dis gbege wey dey hapin for we contri. For Nations Cup own, our morale don low well, well. Make we no tok lie, dem bulala us wella," na im Harouna Dolo tok.

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Sports Talk



John Dykes
Wunderbar Wembley date
I’m honoured to be part of SuperSport’s presentation team for this weekend’s Uefa Champions League...

Neil Tovey
Why Baxter’s way has worked
When Kaizer Chiefs first announced the appointment of Stuart Baxter, the decision was met with a...

Dr Errol Sweeney
Why are referees explaining their decisions?
Match officials make mistakes because they are like you and me - human. However, in modern...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...