Eric Abidal don land
by Andrew Randa 06 February 2013, 11:42
Barcelona France defenda Eric Abidal don enta full training for the
fess time inside 10 months afta dem do operashun comot in liver put
anoda one, the klub confirm for Tuesday.
Abidal, wey bin do operashun comot the tumor wey dey ontop in liver
for March 2011, before in come play for the champion Lig final dat
year wey Barca win Manchester United, neva play since in change the
liver lass April.
But as e come be, the 33 years player dey the team wey assistan coachi
Jordi Roura don cari wey go take play Getafe for Sunday
" Afta in don spend small time for hospital make e check as the bodi
b, the France defenda don start to train on top field" Barca tok for
statement wey comot for deir website
Roura na in b oga now becos the Coachi gon gon Tito Vilanova sef dey
relax small as in dey try well from the saliva wahala wey bin dey wori
am