Real Mallorca tell Caparros to pack go
by Andrew Randa 05 February 2013, 08:28
Real Mallorca don sack deir coachi Joaquin Caparros afta all the yeye
result wey dem don dey get wey leave dem for second to the lass for
the La Liga table.
Mallorca bin catch fire wen seasin start, win three match and draw two
from the fess five match wen seasin start, but deir form sef don drop
anyhow since dat time, and Sunday difit sef for Real Sociedad na the
final slap wey the klub board fit kollect.
Acting Presido Lorenzo Serra Ferrer bin confam say Caparros don waka
for press konfirence for Monday
" I no hapi at all to announse say we don sack Caparros, but we
suppose do somtin, make we find roe , tie oursef for La Liga" Serra
Ferrer tok
Gregorio Manzano, wey b Mallorca coachi dat time wey dem win Kings Cup
for the fess and lass time for June 2003, and foma Real Madrid coachi
Bernd Schuster na the two coachi wey media pipu dey tink say fit
kollect the work.
Capparos, bin enta the work for Oktoba 2011, afta Michael Laudrup bin
resign, and in don also work for Sevilla, Deportivo La Coruna and
Atletico Bilbao.