Cech na best for Czech
by Andrew Randa 05 February 2013, 08:32
Chelsea golkipa, Petr Cech don kollect the award for the best playa
wey come from Czech Republic for the year 2012.
The 30 years Czech Intanashunal bin win the award wey playas,coaches,
federashun offishals and jonalist dem vote, na in numba five strait
award be dat and numba six pata-pata.
Werder Bremen defenda Theodor Gebre Selassie bin come secon and
Hamburg midfielda Petr Jiracek dey back for numba three.
Lass year, Cech bin win Europe Champion Lig wit in klub Chelsea and
come help Czech Republic reach the quata-final for the Europe
Championship wey dem play for Poland and Ukraine.
Cech bin break the small finga wey dey in hand for the 3-2 difit wey
Newcastle do dem for Premier Lig for Saturday and go miss the friendli
wey Czech Republic get wit Turkey for Wednesday