Wahala dey for Spain
by Andrew Randa 04 February 2013, 16:16
Wahala don dey plenti for Spain coachi Vicente del Bosque as noda
playa don widraw for the team wey go play Uruguay for the friendli wey
dem get. Xabi Alonso bin tok say in go miss the match and now sef
Barcelona midfielda Xavi too don widraw, the Spain football federation
( RFEF) tok for Monday.
The 33 years ogbonge playa, wey for don chop in numba 120 match for
Spain if say in play the South America champion dem for Doha on
Wednesday, don meet RFEF medico pipu afta Barca match wit Valencia wey
finish 1-1, the federation yarn for deir twitter.
Spain wey b world and Europe champion don loss Real Madrid midfielda
Xabi Alonso as we don tok as in wound for the 1-0 wey Granada beat in
team Real Madrid.
Na Atletico Madrid playa Mario Suarez wey b 25 years and na foma
junior intanashunal take replace am. But the federation no tok who go
replace Xavi sha