Reds and Coutinho don chop knuckle
by Andrew Randa 30 January 2013, 22:18
Liverpool don complit deal make dem sign Brazil midfielda Philippe
Coutinho from Inter Milan for veri long kontrak, the Premier Lig klub
annouse for Wednesday.
The 20 years playa don become the second playa wey Liverpool don sign
for dis Januari windo afta Daniel Sturridge bin show from Chelsea
earli earli for dis mont.
Dem no gree tok the kain kulele wey change hand for the deal, but
british media pipu dey yarn say the kishi fit reach dat kain 8.5
million pounds. ($13.39 million).
" I dey para dey hapi, my belle dey swit me well well, na veri impotan
parade for my karia, i dey show for here to tap beta soka, help my
team" the playa tok for the klub website (www.liverpoolfc.com)
" Liverpool na korrect klub wih beta playa, i don hear deir stori tey
tey for Brazil sef. They b klub wey show interest say dem want me well
well, so me bilif say dem like me, come like the way i dey tap
ball."
Coutinho don play onli one match for Brazil dem and in enta Inter
Milan from Vasco da Gama for 2010.
In bin cathc fire wey in fess show for, but tins come hard am lata, to
find shirt sef come hard for the Serie A klub and fans sef come dey
tok say in no full ground kakaraka, get strong bodi plat for
Italo.
Dem bin loan am go Spain klub Espanyol lass season and dat side sef
get as e b even as in score five gol inside the 16 match wey in
play.
Liverpool managing direkto Ian Ayre tok say the klub fight well well
to kollect the Brazil playa becos oda klubs like Southampton sef don
dey chuk eye for in side.
" We dey always jolly if we sign the playas wey we want" Ayre tok
" We halla oh, we try well well before e hapin,m wen we fess start,
Inter sef dey do inishial gra gra
" But we no shake, we jus join hand wella follow the mata, and i dey
hapi say e don hapin"