Rangers don land Young from Korea
by Andrew Randa 30 January 2013, 22:07
Queens Park Rangers don annouse on Wednesday say dem don sign South
Korea Intanashunal defenda Yun Suk Young for three and haff year
kontrak.
The 22 years playa go join the West London klub wey dey relegashun
wahala, and wey take style cari three point dey lass for table from
Korea klub Chunham Dragons.
Yun wey bin dey the South Korea team wey win bronze for the Olympics
wey dem do for London lass year don also play in fess match fro Korea
senior team for the World Cup qualifaya wey dem play lass year
QPR bin yarn for deir website(www.qpr.co.uk) say the Korea playa don
arrange work permit finish ( na pamishunn for forina make e work for
UK b dat) and go dey readi to tap ball once in don arrange visa.