*All times CAT (GMT+2)

Football | Tori for Pidgin

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience
Bafana fans © Action Images

Igesund dey pray for open game



Bafana Bafan coachi, Gordon Igesund, tok say he wan make Morocco attak South Africa wen de two contri face diasef on Sunday, for de las match for inside Group A.

South Africa dey fin draw to reach las eight, but dem go dey use one eye dey shadow Morocco, becos dose ones dey fin three point to take reach las eight.

”I dey look am say dem go attak us well, well becos e mean say de match go opin,” na im Igesund yarn amebo dem on Saturday.

”If na so e be, den we go waya dem.”

”We go see wetin dem wan do sha. Dem musto win if dem wan enta las eight.”

Igesund tok say hin playa, Lehlohonolo Majoro, wound no mean say e fit no play but hin go know how Tokelo Rantie wound go be afta.

”Me and doki bin dey yarn jus now and he tok say if we wan make Majoro play, we fit risk am.”

”Na sontin wey we go tink well, well but we neva sabi wetin we go do sha,” na im Igesund tok.

”Rantie no do anytin yestaday and dem bin dey treat am for nite. Dem out ice-block for hin leg and we go see how hin own be for aftanoon.”

Majoro bin wound beta wound for leg, for dia las match, wey dokita dem bin sew sef, and Rantie ankle bin turn one kin, for inside de same match.

Two playa wey don well na Kagisho Dikgacoi (hin bin wound hin knee) and Lerato Chabangu (na hin blokos side he wound), afta dem bin wound bifor South Africa match wit Angola.

South Africa fit enta las eight if dem win, play draw or Morocco waya dem sef. If Morocco waya dem sha, dem go dey pray make Angola waya Cape Verde, or make dem play draw sef.

Morocco musto win if dem wan be sure-banker for las eight, but if dem play darw and de oda match play draw too, Morocco fit still enta.

”All of us sabi say Morocco sabi tap ball well, well and dem get coret team,” na im Igesund tok.

”Dem get playa wey dey tap dia club futbal for Liverpool, Galatasaray, Fiorentina....so dem get ogbonge team.”

”De match go sweet and e go tuff becos we dey play pipu wey no send again. Dem go dey risk tins and we sef musto redi for dem.”

De coachi come yarn say hin team no go sleep at all becos “dem sabi wetin dem suppose do” for inside Moses Mabhida Stadium wey 50 tausan pipu go full, to come watch de match.

”My team sabi say we neva do anytin,” na im Igesund tok.

”We neva let anybodi score us. We dey tap beta ball as we dey go so and we don win our fess match for dis Nations Cup.”

”Our belle sweet small, but we sabi say we get beta work for front on Sunday.”

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Sports Talk



Dr Errol Sweeney
Why are referees explaining their decisions?
Match officials make mistakes because they are like you and me - human. However, in modern...

John Dykes
A day for sentiment, stats and hard cash
The title may have been won weeks ago and the relegation issues settled seven days back but there...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...

Neil Tovey
Khune top of the class
Kaizer Chiefs are on the verge of clinching their first league title since 2005. One man’s name is...