Coloccini and Newcastle don break cola
by Andrew Randa 26 January 2013, 12:51
Premier Lig club Newcastle United don announce say deir Argentina
kaptin and defenda Fabricio Coloccini go dey the club at least till
seasin finish.
The playa wey be 31 years bin tell the klub say in wan go back house
for Argentina as per some tins wey ground wey in no wan yarn, but afta
dem beg am finish, come negoatiate join, in don gree now say in go
stay for St. James Park for now sha, and in go still be skippo.
" Colocinni dey kampe , in go dey wit us as skippo, dat one sef na
korrect ogbonge news for us oh" Newcastle manaja Alan Pardew
tok
" We don manage tok to am, we nid am too even as in pipu take nid am.
In don show korrect loyalti take play for us,a nd in go help us till
seasin finish at liss"
Coloccini advisa dem bin travel go Tyneside go relate with Newcastle
as per make dem rilis am from the four yer deal wey in sign jus lass
seasin ( Newcastle sef for no gree for dat kain mata).
The gist sef bin come for d time wey Newcastle don sign three France
playa, Mapou Yanga-Mbiwa, Massadio Haidara plus Yoan Gouffran.
Toulouse sef come later yarn say dem playa, Moussa Sissokho go soon
show for St. James Park
Newcastle no get any match dis weekend afta dem bin komot for FA Cup
wen Brighton bin do dem strong tin, but dem go play Aston Villa for
Premier Lig dis Tuesday wey dey come.