*All times CAT (GMT+2)

Football | Naija

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience
Sneijder © Reuters Images

Sneijder don join Galatasaray



Holland midfielder Wesley Sneijder don waka join Turkey club Galatasaray afta all the gbege wey hapin as per in kontrak for Inter Milan, the playa bin tok for Sunday.

Sneijder confam the gist say in don gree with everi for the telephone intaview wey in do with Galatasaray website ( www.galatasaray.org) and in dey hope to play in fess match for thr derbi wey dem get with Besiktas one week from today.

" E do craze oh! I go like the the way the stadium go dey with all the fans dem, i no fit wait oh, me wan waka dere go tap ball" the 28 years old player tok.

" I go try make Galatasaray fans dey veri proud and make dem jolly. I wan see dem, holla, come chop knuckle so dat we go dey move togeda."

Sneijder na one of the ogbonge playas for 2009-2010 seasin, and even as e be say in form don drop small, the way in waka go Turkey go surprise plenti pipu wey go feel say in for stay for Europe dem, big big kontri

The korrect freekick specialist bin join Inter Milan for 2009 afta in spend two seasin for Real Madrid, come hel Inter win one Serie A, Champion Lig plus Italian Cup for in fess seasin for the club dat time wey Jose Mourinho b dier coachi.

In also help Holland reach the World Cup final for 2010, dem even beat Brazil for road to reach the final.

Sneijder don join oda playas wey don waka lif Italo Lig, playas like Zlatan Ibrahimovic and Thiago Silva don step waka from Inter dem nebo AC Milan and Ezequiel Lavezzi sef lif Napoli.

The Holland playa gbege wit Inter bin start for Decemba time wen the klub bin ask m to extend in kontrak from 2015 make e reach 206 for the same moni wey dem dey pay am, even world playa union FIFPro bin yab the runs.

.Since dat time, Inter no kuku come dey pay am even as coachi Andrea Stramaccioni dey claim say na becos of taktikal reasin.

Na onli three time Sneijder don play for Serie A dis seasin.

Galatasaray dey numba one for Turkey Supa Lig and dem go play Besiktas for Jan 27. Sneijder tok say in go show for Instanbul come take introduce reach suppotas for Monday. " I go readi for dat game," in tok.

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Sports Talk



John Dykes
A day for sentiment, stats and hard cash
The title may have been won weeks ago and the relegation issues settled seven days back but there...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...

Neil Tovey
Khune top of the class
Kaizer Chiefs are on the verge of clinching their first league title since 2005. One man’s name is...

Clyde Tlou
Enough is enough with racists
We love it so much and even call it the beautiful game but the beauty of this game we love so much...