Mali na dem fess win
by Ibitoye Shittu 21 January 2013, 07:27
Mali don break the 2013 Afcon record as na dem be the fess country to record a win for South Africa as the fess three games wey dem play na draw.
Na Seidu Keita be de man of de match as na im score de onli goal in the 83rd minute wey Mali take bulala Niger 1-0.
DR Congo also fight back as dem play 2-2 draw with Ghana on Sunday for de Stadium wey dey Port Elizabeth.
Emmanuel Badu of Ghana na him score de fess goal against Congo for dis 2013 Afcon tornament, but him goal no helep Ghana as na draw dem play against Congo.
Meanwhile, Zambia presido, Sata don arrive South Africa as him don beg him boys make dem wallop Ethiopia and any other team wey go come dia way.
Action don reach group C today wey be Monday as the Naija Supa Eagus go tacku Burkina Faso, while de current chairmen wey be Zambia (chipolopolo na im be dia nickname) go face Ethiopia.