Falcao injuri no too bad
by Andrew Randa 21 January 2013, 20:49
Atletico Madrid Strika Radamel Falcao bin damage in left hamstring
(na the muscle wey dey the back of in left leg be dat) for the 2-0
kondo wey dem dash Levante for house on Sunday, but as dem come do
scan, e come show say the tin no too serious as dem fess tink am, the
klub bin yan on Monday.
" We no c any sign say in tear anytin for the test, wahala for dey if
say na tear in tear d muscle" Atletico bin tok for statement wey komot
for deir website ( www.clubatleticomadrid.com)
The ogbonge Colombia strika wey don hama 18 gol for La Liga dis
seasin, bin komot field dey hol in leg, and as e bad reach, dem gast
komot am for the 59 minut for the match wey dem play for Estadio
Vicente Calderon ( na Atletico Madrid Stadium b dat).
Atletico Madrid don win 10 strait match wey dem don play for house
this seasin and na dem dey numba two for table.
Coachi Diego Simeone bin tok for news conference wey dem do afta the
matcg say the "senior" player wey all the big big rich klubs fro
Europe dey find go fit miss dat kain 3 weeks.