Blues no gree Gunners
by Andrew Randa 20 January 2013, 23:43
Chelsea don put sand for Arsenal garri hope to chop the numba four
posishun for Lig wit 2-1 win wey dem manage win for Stamford Bridge
for Sunday.
Rafael Benitez boys bin score two gols sharply for inside the fess 16
minut wen Juan Mata gol and Frank Lampard penarity bin put dem for
front, come struggle make dem hold the lead as game dey finish
Theo Walcott arrange better gol wey gif Arsenal hope, but the gunnas
now dey ogbonge 11 point for Chelsea bak wey dey numba three for
table, six point for Tottenham bak wey dey numba four, and dem fit
extend the point sef.
Na onli one match Arsenal don win inside the lass five match wey dem
play for seasin wey dey bita like alomo, even as dem dey even struggle
to take qualify for Champion Lig.
Snow sef come slow tins for London side for Sunday and as e dey fall
dey come pipu begin tink say the match no fit hold again,
The blues sef jus wen one home match since Benitez kollect the work,
and the loss wey dem loss against Swansea and QPR don incris the gbege
wey the Spain coachi get wit the fans dem
Giroud miss the fess chance for the match as in shot ball anyhow wen
in bin get the chance.
The miss come ginger Chelsea go score gol even as e be say yawa dey
for the gol wey Chelsea score. Ramires kollect ball from Coquelin, but
e come be like say in hit am for leg, Chelsea sef no wait, Azpilicueta
lift pass gif Mata, and the Spain playa sef no waste time, in run pass
Sagna come score the fess gol.
Coachi Wenger bin vex, tear head for the refuree say na foul but the
gol stand.
Arsenal sef come vex, begin dey tap ball, Carzola shot from outside
eitin bring fibe save comot from Kipa Petr Cech.
Story come change again wen Mata kollect ball come rilis Ramires wey
run enta Arsenal box, Szczesny come scatta am fro ground, refuree sef
come gif Chelsea penarity, Lampard no make mistake at all, in cari am
well well come score the second gol for Chelsea dem.
Ramires bin suppose close door for the match but in no connect ball
well wellfor the haff wey Arsenal dey play like say dem get
belle.
Arsenal enta the secon haff with korrect swag, dey tap well well pass
the way wey dem play for the fess haff, chances bin dey for Per
Mertesacker and Giroud but dem no fit konvat.
The pressure wey Arsenal put for Chelsea come gel lata, wen Walcott (
wey just sign new kontrak) run come meet Carzola pass, slap ogbonge
ball wey beat Cech rest for insdie net.
Liver comef ail Chelsea as dem come dey do like say wetin hapin wen
dem allow Southampton draw afta dem bin score two go hapin again, as
Arsenal come dey push make dem find anoda gol.
Demba Ba wey enta as subsitute for don ice water the mata, but Thomas
Vermalean dey line to clear in shot afta in don beat Sczcesny, but
Chelsea take manage hol ASrsenal till game finish