Barca lose fess game
by Andrew Randa 20 January 2013, 04:36
Gol wey dem score for injuri time by Imanol Agirrete make Real
Sociedad beat 10 man Barcelona 3-2 come nack dem deir fess loss dis
seasin wey be say dem don set rekod for La Liga.
Lionel Messi bin score for the 10 strait match, put Barca for front
afta juss six minut before Pedro sef come add another one to male am
two gol
Chory Castro sef sccore for Sociedad beforedem enta haff time and come
score in secon gol for the 63 minut.
As refuree come nack Pique red card, Sociedad come enta dem begin dey
fin anoda gol wey come for the 91 minut.
" I wan congratulate Real Sociedad, and i no go complain of my playas
dem. We hit post two times for fess haff and we kuku get two chaces
sef. E come be one kain for us and dem come score to make am 2-1"
Barca coachi Tito Vilanova tok.
" I bin tell Gerard (na Pique b dat) afta dem show am yellow kard, say
the next foul in do go b red kard, and na so e come b. We bin kontrol
d game for the fess haf, and even say e bin hard small, we bin dey
play well, if say na 3-0, we for win am, but d red kard sef come spoil
d mata."
Messi don dey add to all the rekod wey in get, as e b now, in don
score for 10 strait match for d secon time, e do d same tin sef for
2011-12 seasin wen in score 18 gol dat time.
The rekod don equal Ronaldo own, wey score 12 gol inside 10 match dat
time for 1996-97 seasin and Mariano Martin wey scatta 18 gol for 10
match between 1942 and 1943.
Messi don hit 15 gol for 10 match and in get 29 gol total for Lig dis
seasin, but the gol sef no coolu temper.
Even as dem done lose, Barca still dey Atletico Madrid front with
korrect 11 point, wey dey play Levante for Sunday and Real Madrid wey
go play Valencia dey bak bak , na 18 point separate dem and Barca
sef.
Barca start d match wit Andres Iniesta , Messi and Pedro becos Alexis
Sanchez no dey form and Dvid Villa don injur.
Real Sociedad bin dey play defensive futbol, dem pack Markel Bergara
for midfiled, insted of Ruben Pardo but dat one sef no come mean
anytin becos Barca jus dey atak dey go.
Iniesta find Messi wit beta pass and the Argentina star no waste slap
the ball enta net pass Real Sociedad Kipa Claudio Bravo
Pedro shot come hit post before Dani Alves supply am cross wey in cari
score
Real sef come score deir own, Carlos Vela find space gif Castro ball,
Castro sef cari shot wey squeez enta net.
Wen secon haff show, Pique come chop yellow kard for foul wey in do,
the foma Manchesta United defenda come foul anoda playa and the
refuree come nack am secon yellow, wey don be red b dat.
Real Sociedad come dey press Barca becos dem don plenti pass dem,
Asier Illarramendi cross find Castro and in shot sef come deflek for
Mascherano bodi enta net.
Barca bin no fit add to deir gols insted na Sociedad come score to
make am 3-2 insdie the lass lass minute for the match wen Agirretxe
score.