*All times CAT (GMT+2)

Football | Naija

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience
Adkins © Action Images

Southampton fire and hire



Southampton don sack deir manaja Nigel Adkins on Friday come cari Mauricio Pochettino ( wey b from Aregntina) put for in chair, the move sef surprise veribodi as per dier results for Premier Lig bin don start to improf sef.

The sack wey dem dem sack am just come two days afta the korrect ball wey dem tap, dem bin dey lose 2-0 to Chelsea before dem come sharp teeth manage draw the match 2-2. The form sef bin don dey pik, as per na onli two match wey dem don lose inside the lass 12 Premier Lig match wey dem don play.

Na numba 15 dem dey for table come take three point coot for relegashun wahala.

" The decision wey we take na one way b say we do becos of wetin we wan do for front for plenti years to come for Southampton Futbol Klub" executif chairmo for the klub Nicola Cortese bin tok for statement wey comot for the club website, www.saintsfc.co.uk

"Even as we sef dey thank wetin Nigel don help us do for the klub for the two years wey in dey hear, wetin we do na for the klub progress for wetin we sef wan achieve for inside future."

Adkins bin join the south-coast klub for 2010 and come help dem win promotion two times inside two seasin, from League one, enta championship, from there sef, e cari dem enta Premier Lig. Na the fess time e don hapin for dem since 2005 wey dem relegate.

Southampton kuku no waste time, come cari the work gif foma Espanyol manaja Pochettino ( wey b 40 years).

" Mauricio na ogbonge coachi wey pipu dey respect, in get beter qualiti and na korrect tactishan, and sabi manage pipu well well" Cortese tok.

" Confido full me say in go ginger we players make dem maya tap ball well for veri high level sef"

Pochettino fess match go b the Premier Lig match wey dem get for house wit Everton dem for Monday

" Na the kain oppotuniti wey everi coachi go joly for" the foma Argentina player tok for statement wey komot.

" Southampton na klub wey get ogbonge histori, get heritage and the future sef go dey kampe. Dem don clear eye see wetin dem wan make the klub be for futre, wey fit help dem remain for Premier Lig, and even pass dat one, and i hapi say me sef dey part of the parole."

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Live Video Streaming

Sat, 25 May @ 10:50
Sat, 25 May @ 10:55
Sat, 25 May @ 11:30
Sat, 25 May @ 13:55

Sports Talk



John Dykes
Wunderbar Wembley date
I’m honoured to be part of SuperSport’s presentation team for this weekend’s Uefa Champions League...

Neil Tovey
Why Baxter’s way has worked
When Kaizer Chiefs first announced the appointment of Stuart Baxter, the decision was met with a...

Dr Errol Sweeney
Why are referees explaining their decisions?
Match officials make mistakes because they are like you and me - human. However, in modern...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...