QPR don dey eye Remy well well
by Andrew Randa 16 January 2013, 14:20
E be like say Queens Park Rangers don elbow deir Premier Lig rival dem
Newcastle United comot for line, for Loic Remy market as per who in go
sign for.
QPR manaja, Harry Redknapp bin tok for Tuesday say Remy, wey b 26
years don alreadi do medical for Loftus Road ( na the name of their
Stadium be dat)
Olympique Marseille sef bin yarn on Sunday say dem don gree to sell
Remy go Newcastle, but QPR wey dey lass for table don nearli finish to
sign the playa wey don wear France shirt 17 time.
Media repot bin qoute Redknapp afta dem win dier FA Cup third round
replay for West Brom side as in yarn say Remy bin don show for deir
side, don kuku do medical join.
QPR dey still hope say dem go fit sign Rennes midfielder Yann
M'villa, even as Redkanpp dey try make in team strong kakaraka so dat
dem go fight fight make dem no relegate.
" Loic Remy don do medical for we side, and e b like say everytin don
tight, no lele" Redknapp tell BBC Radio pipu.