United manage beat Liverpool
by Andrew Randa 14 January 2013, 06:07
Manchesta United manage hold Liverpool wahala wey match wan finish
come neat dem rival 2-1 for the Premier Lig match wey dem play for
Sunday wey make United cari padlok, lok deir numba one posishun for
table.
Robin van Persie hama in numba 17 gol dis seasin for 19 minut and e
come be like say United go waya Liverpool for Old Trafford as Nemanja
Vidic head ball enta to make am 2-0 for the 54 minut.
But Liverpool sef bin get oda plan, Daniel Sturridge, wey enta as
substitute for secon haf come score, three minute afta United own, the
game come tight from dere, Liverpool push well well, but Brendan
Rodgers and in boy s no come fit find the equalizer.
Manchesta United & Liverpool na the most succesful klub for Ingiland,
any match between dem na helele, two of dem dey share 37 Lig titles,
infak, the game sef come b kompitishun between Van Persie and
Liverpool strika Luis Suarez, and na the numba one strika for the Lig,
Van Persie win dis one.
Suarez no make noise at all for the match, United fans sef hapi like
dat come dey boo am anytime in touch ball as per the gbege wey in and
Evra, Van Persie sef no match brake for the ogbonge form wey in dey as
in gols dey help Manchesta United gap City
The Holland Strika shoe Daniel Agger in numba come jab Evra cross enta
net, come score in numba 9 gol inside the lass nine match wey in don
play. Van Persie sef don score at least one gol for inside 9 for the
lass 10 match wey in play.
" Robin van Persie dey anoda level" United strika Danny Welbeck tok. E
dey do some kain tins wey pipu no fit do, i hapi say in dey we
side"
Liverpool midfield jus dey dash ball anyhow, come dey siddon far far
inside deir half dey invite United make dem attack dem, and dem
suppose scre more than the one wey dem score for tthe fess half
Welbeck, wey manage start d match becos Wayne Rooney stil dey injur,
hit ball go yonder, Tom Cleverly too nearli score wit shot. Van Persie
shibobo ( na wetin South Africa pipu dey call 'Osii' ) nearli enta
net, but Martin Skrtel clear am for line, befor Pepe Reina come push
the ball as Shinji Kagawa dey rush dey come.
Wetin the fess half show be say, levels don change between the two
teams dem, things don change, no be like before, the lass time
Liverpool win the Lig na for 1990, but mata change for the secon
haf.
As Sturridge show ( na im fess match for Liverpool for Lig be dis)
Liverppol sef come inprof, in speed and energi start to dey wori
United defense.
The foma Chelsea strika score afta United add anoda gol when Van
Persie freekick meet Evra head befor Vidic come deflect am wit in head
enta net.
Liverpool sef vex, come comot sharp sharp, Sturridge jab ball enta net
afta United golkipa David de Gea no fit hol Steven Gerrard shot.
Sturridge and Fabio Borini, wey also enta field for secon haf come try
score as United fans dem come dey shift for deir seat. Sturridge for
take equalise for the 85 minut but in shot go ova d bar
United wey sabi win fight lass lass dis seasin,( dem no sabi cari
lass) don cari ogbonge 24 point gap Liverpool, wey dey numba 8 for the
Lig table.