Mancini no gree for kompany red
by Andrew Randa 14 January 2013, 12:48
Manchesta Citu coachi Roberto Mancini dey jolly no b small becos in
team win deir fess game for Arsenal house since 1975, but the refuree
sef come pur sand for the matter as per the red card wey in nack their
kaptain Vincent Kompany.
Mancini come leta tok say dem go apil d red card wey the Belgium
central defenda get for the tackle wey in takle Jack Wilshere, even as
e be say na im win the ball but in two feet no dey ground
" We go appil am oh, we get plenti wahala, wey dey miss penti playas"
Mancini tell repotas dem, in even say na one leg in take enta the
tackle and na in get the ball fess.
" Na serious para make e b say playa go miss three match juss like
dat, for notin sef"
"No b foul, no b red card matta"
" Sergio Aguero, Yaya Toure and Samir Nasri all miss the match, but
City win sef sweet Mancini, even as e b say Arsenal dem France
defenda, Laurent Koscielny add jara for dem afta in waka comot for
field for the fess 10 minut wey match start
The Italo coachi no shake at all as in bilif say wetin Koscielny do na
red card and na penarity stil.
"The rule tok say lass man" in tok, as per the way Koscielny hol Edin
Dzeko for waist inside Arsenal dem box befor in come push am fall down
yakata.
Dzeko kuku miss the pena, the ball hit kipa, come hit post befor the
golkipa manage catch the ball, but e no tey befor City score, na James
Milner korrect shot for 21 minut cari dem enta front.
Bosnia Strika Edin Dzeko come make am 2-0 befor haf time reach.
.
Before match start, City fans sef no come gree kollect the tickets wey
Arsenal pipu send dem make dem take come Emirates, dem return like 900
tickets for inside the 3,000 wey dem get cos dem no gree pay the
ogbonge price wey Arsenal dey price the ticket dem ,62 pound in im dem
charge ( na $100 be dat oh! Choi !)
As e come be, City fans sef kuku dey jolly for dier side for the
stadium take dey jolly dey happi as per na the fess time since dat
time for Oktoba 4, 1975.
Dat time sef Manchesta City no too big like now, dem bin even relegate
enta division three wen Arsenal sef dey kampe for top dey, win cup,
but levels don change now, no nid to tell man where all the cups dey
go nowadays, abi na which team go fit win cup now.
City still dey numba two for table dey look Manchesta United wey beat
Liverpool 2-1 ,dem bak with seven point
'"Na veri impotan win, wey we win. W e sabi say e go hard to come play
for dis side" Mancini add join
" United na strong team and as e b now dem dey ball no b small, but
seasin long sha.
" I no tink say we supose dey seven point for deir bak"