City quench Gunners
by Andrew Randa 14 January 2013, 06:13
Manchesta City don put light for deir road as per the Lig titlea s dem
wire Arsenal two kondo. The champion dem beat Arsenal wey play with 10
playas take rekod their fess win for Arsenal house since 38 years wey
pass.
Roberto Mancini and in boys sef sabi say na to win get dem for
Emirates Stadium if dem wan get hope to catch Manchesta United wey bin
beat Liverpool 2-1 for the match wey dem bin play.
City , wey b numba two for table enta d match with confido say dem go
fit win for Arsenal house comoe wash the shame wey dey since Okoba
1975.
But the game kukuma change wen Arsenal defenda Laurent Koscielny chop
rec card from refuree Mike Dean for d profesunal foul wey in foul Edin
Dzeko.
Dzeko sef come miss the penarity wey in get for the foul, but City no
siddon, dem hol Arsenal for throat as per dem get playas pass dem for
field, come nack dem two gols before haff time reach, Na James Milner
and Edin Dzeko score the gols
City Kaptain, Vincent Komany kollet in own red card wen match nearli
finish, but dat one no fit help Arsenal dem come bak, and as e be,
City wey don win five match inside the lass six wey dem play go feel
say dem go stil fit catch Maanchesta United come cancil the seven
point wey Uniyed nack for deir head.
As the mata come be, Arsenal don dey miss road, to qualify for
Champion Lig don dey look like person wey get cr but d car no get
tyre, dem far from the numba four posishun wey Tottenham get
City fans bin retun plenti tickets go back come refuse to pay the £62
( 83 dollars) wey Arsenal dey charge for tickets cos say e too
cost.
Yawa nearli gas before match start sef as police show for Emirates
becos sometin wey be like bomb bin dey where dem dey park car, but na
Arsenal defending come woss pass for the mata.
Koscielny hold Dzeko like say na wrestling dem dey do for village for
market day, come drag am reach ground, refee Mike Dean no kukuma waste
time, e gif Manchesta City penarity , come nack Koscielny red card
join
Wojciech Szczesny come save the penarity as in use in leg stop the
ball before in catch am as the ball wan cross line. But e no come tey
wey City sef score, Gareth Barry pass ball reach David Silva, Silva
come find Carlos Tevez, Arsenal defence come allow dem space anyhow,
Tevez come find James Milner, Milner no waste time come cari beta shot
wey Sczesny no get ansa for.
Arsenal defense wey dey b like biskit no go be problrm for Manchesa
City dem wey get one man advantage and na for the 32nd minut the secon
gol show.
Pablo Zabaleta gif Kieron Gibbs bodi kollect ball, come rilis Milner,
as in c plenti space, in cross ball wey Carlos Tevez meet, Tevez shot
come pepper Szczesny for hand, as in palm the ball, Dzeko sef say
'thank you' tap ball enta emti net.
Jack Wilshere come save Arsenal as in clear ball coot on top line from
Javi Garcia header before haf time reach.
City no come wori, dem just siddon cooley dey gaurd deir side. Mike
Dean come gif Arsenal small hope as in dash Vincent Kompany red card
for the leg wey in chuk reach Wilshere for the 75 minut.
Joleon Lescott clera ball comot for line from Theo Walcott shot as
City manage close market. Arsenal sef no come fit score and the match
come take finish