*All times CAT (GMT+2)

Football | Naija

Note: this article is written in Pidgin English for a Nigerian audience
Zambias headman herve © Backpagepics

Zambia na real 'ogbunigwe'



Garba Lawal wey been tap soccer for Nigeria in those days don warn Super Eagles say make dem no do gadagada take small eye look Zambia for this African Cup of Nations wey dey come o because gadagada dey tear cloth and if person take small pikin play, the small pikin go take am play o.

The thing be say as the Zambia team wey dem dey call Chipolopolo dey try body for the trading tackles, dem just yab come fall yakata give Tanzania and Angola and come manage get only draw with Morocco, but Lawal say all dat result no fit deceive am say Zambia no strong o.

As Lawal view the whole sequence, him come say “true, true, I no fit take small eye look Zambia just sake of say dem yab for the play play match dem. Anybody wey say dem no be matter get to reason well to remember say na dem win the last Nations Cup and before that time, Nigeria been nack dem two kpondo for Kaduna. Dat na for 2011. Because of dat people come dey say dem no sabi anything but na so dem carry waka go win the cup. I don check the whole thing and I don see say I no fit take small eye look this Zambia people and I no want make Super Eagles fall for this kind trap because if dem do anyhow, dem go see anyhow o.”

Zambia people still dey arrange demself and dem go play one oyinbo contri wey dem dey call Norway on Saturday for one town wey dem dey call Ndola, Dat same day, Nigeria go try one club wey dem dey call FC Rotterdam for the town of Faro for Potokiri.

As the whole thing arrange, the two teams dey Group C and Nigeria go jam Zambia in the main the main competition for January 25 for South Africa.

fred.edoreh

Shop

Gerrard: My Autobiography
Steven Gerrard is a hero to millions, not only as the inspirational captain of Liverpool FC, but as a key member of the England team.
R118.00
Red: My autobiography
No player has been more synonymous with the glory years of Manchester United Football Club over the past two decades than right-back Gary Neville.
R195.00
The Professor: Arsene Wenger
Idealistic, passionate and scientific, Arsene Wenger led the modernisation of English football
R138.00
FIFA 13
All-new Attacking Intelligence infuses players with the most sophisticated artificial intelligence ever achieved
R564.95


Comments

More expert analysis and opinion from Sport24
The opinions expressed by Sport24 experts and bloggers are theirs alone, and do not necessarily represent those of SuperSport

Live Video Streaming

Latest Video Highlights

Sports Talk



John Dykes
A day for sentiment, stats and hard cash
The title may have been won weeks ago and the relegation issues settled seven days back but there...

Emeka Enyadike
Beckham, most popular football star
Is David Beckham the most famous football player ever? I tweeted from my @EmekaEnyadike handle and...

Segun Odegbami
Dortmund may surprise favourites
I cannot disguise my interest in Barcelona. I never hide my love for their style of play that is...

Calvin Emeka Onwuka
Not this time Arsenal
The league title is with Robin van Persie and his Manchester United teammates. Man City have...

Neil Tovey
Khune top of the class
Kaizer Chiefs are on the verge of clinching their first league title since 2005. One man’s name is...

Clyde Tlou
Enough is enough with racists
We love it so much and even call it the beautiful game but the beauty of this game we love so much...