'Unfit' Ayew go start for Marseille
by Andrew Randa 13 January 2013, 11:04
Andre Ayew, wey Ghana drop from deir team for the Africa Nations Cup
wey dey shele dis month becos say in no dey fit, don enta Olympique
Marseille team wey go play Sochaux for Sunday, the French Ligue 1 klub
don tok.
The Ogbonge winga, wey don play 44 match for Ghana dem, don recova
from the injuri wey in get dat time wey dem dey train about 10 days
wey pass, the klub bin tok for deir website (www.om.net)
Ayew, wey b 23 years and na foma Ghana player Abedi Pele pikin, bin
suppose show for in National team camp lass weekend make the dokto dem
wey dey Black Stars check am see wetin dey, but in no show, the guyman
jus miss, wey come make Coachi Kwesi Appiah drop am from the playas
wey in wan cari go the Nation Cup.
Strika Morgan Amalfitano and defenda Lucas Mendes, wey dem two miss
the French Cup win ova Guingamp lass weekend dey okay and fit play for
Marseille wey dey numba three for table.
Like Ayew mata, Togo golkipa Kossi Agassa go play for in klub Stade
Reims for Sunday even though dem tok say in no go go Africa Nation Cup
becos of knee injuri wey dey wori am
Midfielder Odair Fortes, wey widraw from Cape Verde national team
becos of injuri don enta the Reims team wey go play Bastia.
The Africa Nations Cup go shele for South Africa and na from Januari
19 e go start.