Sunderland don sign N'Diaye
by Andrew Randa 10 January 2013, 12:56
Suderland don anounce say dem don sign France dem defensif midfielder
Alfred N'Diaye from Turkey klub Bursaspor for kulele wey dem no gree
tok. N'Diaye wey b 22 years and dey play for France dem U21, bin move
go Turkey from Nancy wey dey France for 2011, do sign join for three
and haf years wit the klub wey come from Ingiland north-east.
" Alfred na strong young playa, in get power and in go help gif us
plenti oda option, add join for the playas wey wey get for ground"
Sunderland Manaja Martin O'Niell bin tell the klub website.
" In go gif us plenti option for we team, i dey jolly say we try
manage bring am come here for the klub"
N'Diaye, wey Bursaspor buy for three million euro wen in take show
from Nancy, na the fess playa wey Sunderland don isign for this
Januari transfa windo wey open.