Rovers bow to Allardyce
by Andrew Randa 08 January 2013, 17:20
Blackburn don apologise to dem foma manaja Sam Allardyce for all the
buju buju yarn wey pesin weu succeed am for d work yarn.
Steve Kean wey dem bin promote enta manaja for Blackburn Rovers afta
dem bin sack Allardyce for 2011 misyarn for inside film wey fans film
am dey tok anyhow about Allardyce.
Blackburn rilis statement for dem website for Tuesday say " Kean bin
falsely accuse our foma manaja Sam Allardyce say in na crook and dat
na the reasin why we sack am, that tori no b true"
The klub sef, wey na India pipu get come add tok say " we dey
apologize to Mr. Allardyce for all the embarrassment wey we cause am
becos of wetin Mr. Kean tok"
Blackburn bin relegate lass seasin from Premier Lig for May time wen
Kean b the coachi. Kean sef don waka, as e be, the pesin wey kollect
the work sef ,Henning Berg don chop kondo lass month wey pass. Now,
Blackburn dey find who go take coach dem.
Sam Allardyce na im dey manaj West Ham now.