Djourou don waka go Germany
by Andrew Randa 06 January 2013, 18:44
Arsenal defenda Johan Djourou don join Hannover wey dey Bundesliga on
loan till seasin finsh. The defenda wey shirt dey hard for the gunnas
join the team from Germany for Saturday and go dey wit dem till june
time.
The Swiss intanational wey b 25 years don play onli two time for
Arsene Wenger team dis seasin, but e neva play for Premier Lig, afta
Thomas Vermaelenm Laurent Koscielny and Per Mertesacker don kollect
all the shirt we remaon for the central defense.
Djourou don play 144 tme for the Gunnas dem since in fess play for the
2-1 win wey dem win Manchesta City for Lig Cup for Oktoba for
2004.
But as e come be , all d yama yama ball wey in dey play plus form wey
in lose come make Wenger kip am for bench.
Statement for Arsenal website bin tok say " Efribodi for Arsenal wan
wish Johan well for d time wey in go take spend for Germany"