RVP don put sand for Man City garri
by Andrew Randa 02 January 2013, 12:30
Manchesta City Manaja Roberto Mancini don tok say d onli risin why
United dey gap dem na becos Robin van Persie no gree show for deir
side, as per no gree join dem, wsaka go Manchesta United
D Holland strika wey join United from Arsenal for 24 million pound
($39 million) lass August don score 14 gol inside 20 Premier Lig match
wey in don play come helep Alex Ferguson tim cari seven point gap
defendin champion dem, Manchesta City
" As e b so, na Van Persie b d onli tin wey dey seperate us" Mancini
tell media pipu dem. " In don score 14 gol for dem, and na d lele b
dat, in don change dem parole.
" Na bumpa to bumpa like three or four mont wey pass beforin enta dat
side, we bin dey sure say we go get am, but e no hapin.
" We bin lik Van Persie becos we know say in dey differen from d
strikas wey we get, we bin wan improf our tim, as per Champion Lig
sef, we nealri nearli sign am, i sabi why in waka go dere, but ii no
go talk am, no b moni mata
" Dat time wey Van Persie join United dem befor seasin start, in bin
talk say " na d small boy wey dey inside me i bin open ear for"
" For dis kain mata na to tink am well well, i dey always open ear
lissin for d small boy wey dey inside me, i bin ask am wetin in want,
e come dey shout Manchesta United1" Van Persie wey b 29 years tok.
Rooney and Van don becom beta patna, United sef don score 50 gol for d
fess 20 match wey dem play, take 12 gol pass City own wey be say na
City dem score pass lass seasin for Lig wen dem bin score 56 gol for d
fess 20 match wey dem play
Sergio Ageuro na im dey form, but Carlos Tevez and Mario Balotelli don
lose form and Dzeko sef na for bench in dey take enat field
" I hapi say my strikas dem b d best scora lass seasin for Premier Lig
" Mancini yarn
" But if u got fit to improf ya tim wit beta playas, den e gud make u
do am. If pesin get Van Persie, e mean say somtime sef u fit enta
three strikas dem for field one time."