Ashley Williams na killer - Ferguson
by Andrew Randa 24 December 2012, 03:21
Manchesta United coachee Alex Ferguson dey vex say Swansea Citi
defenda Ashley Williams for kill Robin van Persie during d 1-1 draw
wey dem play.
D Wales defenda bin take shot hamma Van Persie for head wen im dey
ground for d second haff od deir match, wey come make players dem
start to dey fight inside field. Even as refuree come book Van Persie
and Ashley Williams.
Swansea numba 1 gol man, Michu bi cansil Patrice Evra gol,wey come
stop Fergie and im boys to tak incris d 6 point wey dem get for City
head.
" Robin van Persie lucki say im dey alife " Feguson talk
" Na disgrace wetin dier player do today and d FA sef suppose ban am
for d yeye tin wey im do, im for kuku break Robin neck sef.
" Wetin im do na one of d veri dangeros tin wey i don eva see for
field for plenti plenti years, im sabi wetin im dey do and na for
refuree front e happen"
Williams talk say wetin happen na accident and im tell Sky Sports say
" Me jus clear ball, na vex plus frustrashun i take hit d ball and e
come hit am for head, and d tin vex am.
Swansea catch fire for d beginin of d match, Michu nearly score as im
lif Nemanja Vidic for back run go, before Wayne Rooney sef and Ashley
Young pepper Swansea gol kipa Michel Vorm wey just come back from
injuri.
United come score for d 16 minute and Evra header enta net from d
cross wey Van Persie cross, na im numba 3 gol dis seasin and na with
head e take score all of im gols.
For d 29 minute. Wayne Routledge pass, bin clear space for Jonathan de
Guzman, as im run take shot, De Gea come stop am but Michu dey beta
postion to put d ball inside Manchesta net come score d numba 13 gol
dis seasin
Vorm bin save Rooney shot before halftime reach, and Ferguson sef bin
halla refuree why im no do anytin when Chico Flores bin push Van
Persie fall for ground befor Swansea run go score dier gol.
De Gea sef dey action as im save shot from Routledge and Kemy
Augustine and d two team dey play demselves to see who go score d
winning gol.
Na United fess draw dis seasin be dat for all d kompitishion wey dem
play and na onli four point dem take gap Manchesta City now as dem dey
prepare for Newcastle United match for house.
Arsenal dey 3rd now for table as per d 1-0 win wey dem win Wigan, and
dem be one of d team wey get 30 point, togeda wit Everton, Tottenham
Hotspur and West Bromwich Albion.