Devils still want Ronaldo
by Andrew Randa 22 December 2012, 09:16
Manchesta United defenda Patrice Evra done tell Cristiano Ronaldo say
make im come house ( as per Old Trafford) if im feel say dem no want
am for Real Madrid.
Ronaldo wey waka comot from United for 2009, say make im go Madrid
achiv im dream since im b small pikin, neva get d kain salute wey dem
dey salute am from Premier Lig for La Liga.
United fans dem bin gbadu Ronaldo, but for Madrid, na helele, im
komplain say im no too hapi for dat side, say upon all d ball wey e
dey ball for Madrid, dem no dey appreciate, efen as im helep dem stop
Barcelona dance for dat side, still dem no send am.
Roaldo don score 170 gol inside d 169 match wey im play for Madrid,
and e be like say Real Madrid Chairmo dem no too send becos dem neva
even improf im kontrak, d way wey Barca do for Messi.
And as e come be say United go jam Madrid for the quata final for
champion Lig for d fess time, Evra bilif say im foma tim mate suppose
dey think to waka come back.
" Me and im dey yarn" Evra tell MUTV " Im still gbadu us and im dey
miss dis side.
" Im don do ogbonge tins for Madrid, e efen break plenti plenti rekod,
but dey no dey show am respekt at all,
" Wen Ronny bin dey here, efribodi show am lof, d players dem,
coachee and d fans sef, im na winna, im dey miss United becos n im
area be dat." i dey always hope say one day im go come bak becos dis na im house,
if im wan win d Golden Ball ( Ballon d'Or) im gast to waka come
Manchesta United"
Ronaldo bin win d Ballon d' Or for 2008 wen im scatta 42 gol as United
do double dat seasin, dem win Champion Lig come carry Premier Lig add,
but since dat time na Messi dey shine pass.
Evra bilif say Ronaldo beta pass Messi becos for Madrid, na Ronaldo
dey do efritin imself, na im go create chance wey im go take score,
meanwhile Messi get Xavi and Iniesta wey dey arrange all d beta beta
ball wey Messi dey take score.
" Messi na winch, but Ronaldo winch pass, im dey do on im own, pipul
dey wey dey helep Messi. Evra talk.
As Manchesta dey play Madrid for quata-final for Champion Lig, Evra
talk say no shakin at all, im say Ronaldo sabi say im na toff defenda,
say Ronadlo no fit cari am do yeye
" We don train wit each oda before, im sabi me well well, i hope say
na my wing dem go play am, i know im sikrit, no wahala at all. I know
say im fit make difference anytime , but d pressure fit wori am and e
go good for us."