Uefa don ban Malaga
by Andrew Randa 21 December 2012, 23:30
Uefa don ban Malaga ( wey don dey Champion Lig quata final) from all
dem kompitishun for 1 year wey dey come. Na on Friday Uefa comot say
dem ban Malaga becos dem no pay dem players deir salari and efen tax
sef on time.
Uefa stil talk say d klub wey na some Qatar pipul get, go still get
anoda ban if inside four years dem still do wetin dem do again, If dem
pass March 31 dem neva pay, na kasala b dat. D gbese sef don reach 9
million euro.
Malaga sef come publish statement say Uefa no do well at all, say dem
no dey fair on top dem as per dem wan try do the finanshial fair play
rule wey dem wan bring.
All dis one happen juss one day afta dem do d draw for quata-final wey
carri Malaga mit FC Porto.
Uefa gain come fine dem 300,000 Euro untop all d wahala, d klub sef
fit appil go d court wey dey settle all sport quarrel.
Malaga dey expect say dem go kollect 25 million euro as prize moni
plus dem share for d tv money becos say dem play Champion Lig dis
seasin.
Dem bin qualify for d ogbonge futobal kompitishun wey dey dis world as
per dem come numab 4 for Spain Lig lass year, and dem swagga come rise
wen Qatari business man Sheik Bin Nasser Al Thani bin buy d klub, coe
dey scatta moni dey buy players wit big big moni.
As e be so, d rule now be say all klub must pay dem players salary
plus all d tax wey dem dey follow dem before Uefa go allow dem make
dem play for any of dem kompitishun, ad to kollect lisense sef go b
say d klub don do evri b dat.
Since 2011, Uefa don dey cari eye dey look all d klubs dem, how dem
dey spend moni and how dem dey buy players, and now sef, klub dem must
make profit , or woss woss make dey level wey be say d moni wey dem
spend no go pass d moni wey dey enta.
Anoda 8 klub wey dey Europe sef bin suffa d same wahala as Malaga.
Dinamo and Rapid wey de Bucharest, Sebia Partizan Belgrade and
Croatia Hadjuk Split and Osijek go face 1 year ban inside 3 years if
dem no fit settle deir gbese before March 31.
D oda four sef come kollect fine for 100,000 euro each, dem come oda
Hadjuk make dem pay 80,000 euro.