Villanova no dey well
by Andrew Randa 19 December 2012, 16:45
Barcelona Coachee, Tito Vilanova don suffa again from d same cancer ( wey dey im saliva side) wahala wey dey worry am bifo, El Pais newspepa bin relate as per wetin dem hear from inside d klub.
Vilanova, wey b 43 years, bin do operation for d cancer wey dey worri am lass November so, bim promote from assitant coachee take replace Pep Guardiola dis seasin wey we dey.
Barca pipul dem bin drop yarn say dem don cancil d Christmas gbedu wey dem bin get wit media pipul for dat side and dem Presido Sandro Russell dis morning so. Dem talk say dem go explain wetin happin afta.
" We dey sad, and sori sef wen we bin hear d gist" Barcelona midufilda, Xavi bin talk for im offishial account for Twitter.