Mueller and Bayern don agree
by Andrew Randa 19 December 2012, 19:40
Germany playa Thomas Mueller don extend im kontak wit Bayern Munich,
wey go cari am reach June 2017 inside d klub.
Bayern talk say, Mueller wey join dem from im home town wen im be 11
years, don add 2 years join for d one wey im get, for Wednesday.
Mueller play im fess match for Bundesliga for August 2008, come shine
well well d next year wey gif am shirt carry go World Cup for 2010. Na
im come win d golden boot for d kompitishun sef wit 5 gol. Muellar don
play 38 time for Germany.
D ogbonge player wey be 23 years, and sabi play efriwhere for attak,
dey shine dis seasin, Infact na d best seasin wey im don get for
Bayern be dis. Him dey score dey helep pipul score 21 gol inside d 25
match wey im don play. For Bundesliga sef im don score 9 gol come
helep pipul score anoda 9.