Benzema don win Award
by Andrew Randa 18 December 2012, 22:51
Real Madrid strika Karim Benzema don win award as d korrect (best)
Footballa wey come for France for 2012. Na d secon time inside 2 years
im dey win am so, D Klub bin talk for Tuesday.
France dem playa before before, Zinedine Zidane bin present Benzema
wit d cup for Madrid dem Stadium.
" I jolly well well, and e sweet me as per say na Zidane giv mi d cup
sef, i dey gbadu am since i dey small, for me oh, na im be d best
footballa wey don play for we country France" Benzema tell im klub
website (www.realmadrid.com)
Benzema bin win d award wey France Futobal organise on top Bayern
Munich winga Franck Ribery and Tottenham Hotspur golkipa Hugo Lloris
for d vote wey pipul wey don win am before do, wey Zidane sef drop im
own.
D Olympique Lyon strika bin score 21 gol for La Liga lass seasin, come
helep Real win d Lig, im score 7 goal for Champion Lig before Bayern
Munich bin comot dem for d semi final.
Benzema seasin sef na ice water, as na onli 3 time im don score for
Lig, and im bin miss d 2-2 wey Madrid play Espanyol becos of small
wahala wey dey trouble im leg.